Sahara News
Breaking News in Nigeria and World wide

Accident for Port Harcourt lead to death of five for traffic collision

Five pipo die for fatal accident wey happen for midnight breaking Saturday along di NTA Mgbuoba Road for Port Harcourt.

Di accident occur around 1am, just days afta Rivers State goment lift di night time curfew.

Police confam di incident to BBC Pidgin on Saturday.

‘Dem don deposit di deadi bodi of all five of dem for mortuary as investigation don begin.’

Na wetin Nnamdi Omoni, di tok tok pesinof Rivers Rivers State Police Command tell BBC.

Eye witnesses say di motor wey carry di five pipo, two boys and three girls, go jam one truck wey pack along di road.

Na sewage disposal tanker truck dia car jam and all of dem die on di spot, witnesses add.

Tori be say di victims wey be university students bin dey return from night club wen di accident happen, but police never confam who dem be.

Some residents around wia di accident happun claim say e fit be as a result of over speeding.

Di accident cause heavy traffic gridlock along di NTA/Choba road on Saturday.

Get real time updates directly on you device, subscribe now.

Leave A Reply

Your email address will not be published.

error: Content is protected !!