Sahara News
Breaking News in Nigeria and World wide

Turkey-Syria earthquake: Death toll increase to more dan 28,000 as di freezing weather dey add to rescue challenge

Unrest for southern Turkey don disturb rescue efforts for some places following Monday deadly earthquake, three rescue groups don tok.

Di death toll for Turkey and Syria from di quake don pass 28,000, and hope of finding many more survivors dey fade despite some miraculous rescues.

German rescuers and di Austrian army pause search operations for Saturday.

Dem cite clashes between unnamed groups.

Security dey expected to worsen as food supplies reduce, one rescuer tok.

Turkey president say dem go use emergency powers to punish anyone wey dey break di law.

One Austrian army tok-tok pesin tok for early Saturday say clashes between unidentified groups for di Hatay province don make dozens of personnel from di Austrian Forces Disaster Relief Unit to dey find shelter for one base camp wit oda international organisations.

“E get plenti aggression between factions for Turkey,” Lieutenant Colonel Pierre Kugelweis tok for one statement. “Di chances to save one life no get reasonable relation to di safety risk.”

Hours afta Austria pause dia rescue efforts, di kontri ministry of defence say di Turkish army don step in to offer protection, to allow di rescue operations to resume.

Di German branch of di search and rescue group ISAR and Germany Federal Agency for Technical Relief (TSW) also suspend operations, as dem cite security concerns.

“E get more and more reports of clashes between different factions, shots don also dey fired,” ISAR tok-tok pesin Stefan Heine.

Steven Bayer, operations manager of Isar, tok say e dey expect security to get worse as food, water, and hope become more scarce.

“We dey watch di security situation very closely as e dey develop,” e tok.

German rescue teams say dem go resume work as soon as Turkish authorities don give assurance say e dey safe, Reuters news agency report.

Di Vice President of Turkey, Fuat Oktay announce on Saturday di death toll for Turkey don rise to 24,617.

“We don declare state of emergency,” Oga Erdogan tok during im visit to di disaster zone today. “E mean say, from now on, di pipo wey dey get hand for di looting or kidnapping go know say di state firm hand dey dia backs.”

State media bin report on Saturday say 48 pipo don dey arrested for looting, according to AFP. Turkish state media report say plenti guns dey seized, along wit cash, jewellery and bank cards.

One 26-year-old man wey dey search for im work colleague for di collapsed building for Antakya tell Reuters: “Pipo dey smash di windows and fences of shops and cars.”

Turkish police don also reportedly detain12 pipo over collapsed buildings for di provinces of Gaziantep and Sanliurfa. Dem include contractors, according to di DHA news agency.

E also dey expected say more arrests go shelle afta Oga Oktay tell reporters late Saturday say prosecutors issue 113 arrest warrants over di buildings.

At least 6,000 buildings collapse for Turkey, raising questions about if di large-scale tragedy fit don dey avoided and whether President Recep Tayyip Erdogan gonment fit don do more to save lives.

Wit elections wey dey come, di president future dey on di line afta e don spend 20 years for power and im beg-beg for national unity no carry weight.

Oga Erdogan don admit shortcomings for di response, but e blame fate for visit to one disaster zone: “Dat kind things don always happun. E be part of destiny plan.”

Miraculous rescues afta 100 hours under rubble

Among pipo wey dem rescue on Saturday be family of five from di rubble for Turkey Gaziantep province.

Di same outlet bin report say seven-year-old girl dey pulled from di debris di province of Hatay afta almost 132 hours under di rubble.

Di BBC also publish footage of di remarkable rescue of two sisters for Antakya, southern Turkey, from Wednesday.

Turkey president meet pipo for di quake zone

Wia dis foto come from, Reuters

Turkey president Recep Tayyip Erdogan don defend im goment response to di two catastrophic earthquakes, say e dey impossible to prepare for di level of disaster.

Critics bin claim say di emergency services response bin dey slow and goment bin dey poorly prepared.

Erdogan accept say goment bin encounter some problems, but say di situation now dey “under control”.

Emergency personnel dey search for victims for di site of a collapsed building afta powerful earthquake for di Elbistan district of Kahramanmaras, south-eastern Turkey, on 7 February 2023

Wia dis foto come from, EPA-EFE/REX/Shutterstock

Turkey bin announce three-month state of emergency for 10 provinces wey di earthquake affect well-well.

For one televised address, Erdogan say di state of emergency na to make sure say dem fit carryout rescue work “quickly” for south-east of di kontri.

E say di measures go allow relief workers and financial aid into di affected regions, but e no further details.

Di state of emergency go end just before elections on 14 May, wen Erdogan go attempt to stay in power afta 20 years.

Turkey last impose state of emergency for 2016 afta one failed coup attempt. Dem lift am two years later.

Wetin we call dis Video, Watch: Pipo dey search for pipo for earthquake rubble for Malatya

Turkey declare 7 days of mourning

Turkey declare seven days mourning to mourn dos wey die from di disaster.

President Recep Tayyip Erdogan tweet say, “National mourning period don dey declared for seven days. Our flag go fly for half-mast until night for Sunday 12 February, 2023, for all our national and foreign representative offices dem”.

Plenti kontris don promise aid since di 7.8 magnitude quake wey knack di kontri as pipo bin dey sleep and inside dressing weather wey don affect emergency efforts.

Turkey earthquake

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Rescuers carry one pikin from di site of damaged building, afta one earthquake for Hatay, Turkey, on 7 February 2023

Second earthquake of 7.5 magnitude tremor hit Turkey and Syria around 1:30pm local time on Monday, wey officials say no be aftershock.

Meanwhile Russia President Vladimir Putin, don offer condolence and pledge to give di two kontris aid.

Putin tell Syria President Bashar al-Assad: “We hope for speedy recovery for all di injured and dey ready to provide di assistance wey una need to overcome i impact of dis natural disaster,” AFP news reported.

Schools for di 10 cities and provinces across Turkey wey di earthquake affect go dey closed for one week, di kontri vice president Fuat Oktay tok.

Di cities and provinces na Kahramanmaraş, Hatay, Gaziantep, Osmaniye, Adıyaman, Malatya, Şanlıurfa, Adana, Diyarbakır, Kilis.

Turkish Vice-President Fuat Oktay, say dem don suspend flights wey wan enta or comot di airport for Hatay province, dem don also close di airports for Maraş and Antep to civilian flights.

Syria health ministry say pipo bin die for di provinces of Aleppo, Latakia, Hama and Tartus.

Di US Geological Survey say di 7.8 magnitude tremor strike at 04:17 local time (01:17 GMT) at a depth of 17.9km (11 miles) near di city of Gaziantep.

Turkey Twitter Ban and Building laws

Pipo for Turkey don dey vex for di poor enforcement of building rules na im lead to di collapse of plenti buildings for di two earthquakes wey rock di kontri on Monday.

Up to 75,000 buildings dey affected by di natural disaster.

Di kontri bin don tighten laws on construction afta dis kain kasala sama Turkey before. Di most recent kasala bin happun for 2018.

Dem sama di strict rules afta di 1999 earthquake wet kill 176,000 pipo.

But time afta time, dem dey amend di rules to allow construction wey no follow di laws to pay money dodge di law. Sabi pipo say na wetin cause di kasala wey just happun.

Get real time updates directly on you device, subscribe now.

Leave A Reply

Your email address will not be published.

error: Content is protected !!